My Brief UI 2021 Story with CAMPUSNEWS Checklist
My Brief UI 2021 Story using Campusnews template 😁
Heyo😉, today looks a little drab right! , let's light it up with this jocular yet entertaining piece.
Shall we😁!
Campus News Checklist
TDB /MTN
Na me the Regular customer wey dem Dey talk about 😎😎. Even KDL no dey collect my card anytime I don arrive the portal don sabi me wella.
VOTED IN SU ELECTION ✅
Yes ooo, Èmi odinidin Politician💪, Na OJB's phone in Zik Quadrangle I even use to cast my vote as per say I had no phone at that period (Stories that touch)
SNAPPED IN FRONT OF ECONOMICS DEPARTMENT ✅
Yes ooo
That building is too beautiful to ignore, make dem transfer myb department there, I should go and start receiving lectures there lásán, I go sabi book sharp sharp 💯.
ATE AT ARCHIVES ✅😋
Àmàlà Archives 😋😋😋 will remind you of mom's food at home. And the fact that they have varieties of food to eat from at affordable and student-friendly prices, endeared me to that PLACE. I dey carry people go there to chop sef. Especially after writing tough exams wey go go use Archives amala to step down the depression and after that we mauve😉.
WENT TO AWO STADIUM ✅
Prayer walk🔥, Hangout and the likes brought me there😎. It's a nice place though 🤗. I remember one day wey I sad die, na there I go dey think about my life, ọmọ I cry my eyes out that day, and thank God, nobody dey there that day. But then, Awo stadium get this serene environment wey good for pelsin wey wan think him life through. Make una sef try am!
GOT ARRESTED BY ABEFELE
❌❌❌Errroorrr!
Èmi gentle girl to the core!
Mo gentle jo àdàbà lo🕊️
Abefele sef dey fear me🐤.
DID IDIA/AWO/QUEENS 101....
Nah!, I'm a lady, I no be gay😁. But if na Tedder 101,
Ykkkkkkkk😉😉😉😉 (MY GEE DON SABI ME)
ENJOYED AT SPICES 🙁🥺
Not yet, but person don dey feed me gist, next session, I fit carry person go there sef😄😉.
ATTENDED MORE THAN 1 DINNER 😏
No, no!
Aseju ni more than one dinner, I'm a full time student, I save for the coming session, not me squandering money on dinner tickets, expect if you dash me, No wahala!
WENT TO AWBA DAM 1/2✅
Na motor carry me pass for there, I neva go there on my own sha, but next session, we fit cruise reach there! 😉
SLEPT OVER AT MALE HOSTEL 🙄
Enipeeee!
Awasubillah, a ní rí iná nínú kanga, ODINDIN Child of God, No, ó wrong gan🙂!
Even Yk and Boogie😉 will organise deliverance if person try am.
COLLECTED COVID VACCINE 😫
Why you con dey remind me?
The day I suppose take am, vaccine just finish before e reach my own turn.
But then ọmọ na God talk say make I no collect am oo, the following day wey I com go house, na em malaria hook me😣😣, i no fit cry, I just dey thank Baba God say Covid no meet malaria for my body, na anoda tori we go dey talk😌.
ATTENDED JAWWAR ✅💯
Yaahhhh! Stand up, Speak up, Shut up!
How I no go ATTEND ? me public speaker of the year, I may not have money to sponsor JawWar now but my noise about it sef, go make you leave everything and go for JawWar. And to say na we bi boss for there, you know what I am saying, Awo L&D 🔥🔥🔥🔥🔥🔥.
CARRIED MARUWA DROP ✅🤑
Yeah! A couple of times, I did OMO BABA OLOWO, SPENDING MONEY 🤑🤑🤑
Especially when I was fatigued from the day's stress or when I have extra money to spare.
Inside the Maruwa, I will now be feeling like boss, like say I dey inside Uber Abi Bolt 😉.But my people, enjoy life if you get the money 😁.
VISITED JAJA 😱🤮
Ewwwwwweeeee!
🤢🤢🤮🤮🤮
Ife, where art thou?
Come and tell this people wetin Jaja use my eye see one time like this for early August.
I weep and wept, thank God for human beings like Ifeoluwa, jeeeezzzz that lady na correct pelsin, I doff my heart for you, dear😘.
ENDED A RELATIONSHIP 😂😂
You say 👂
Unfortunately, I am Relationshiphobic😱, I don't do anything relation....... It gives me creeps, so I didn't bother not to talk less of ending one.
Socrates, don talk am,
MAN KNOW THYSELF, AYANFE KNOW YOUR SELF, YOU HEAR RELA... YOU FLEE BEFORE YOU GO BECOME SLAUGHTER SHEEP IN THE RELATIONSHIP😌😎.
TRANSFERRED URGENT 2K ✅
Well, as I be humble child of God,i no fit dey bragger but the little we fit do, God dey give us grace make we do am.
PRAYED AT CHAPEL TARMAC ✅🔥
Eiiii, my power house! Me wey get plenty village people, I prayed well for Chapel ooo. Make devil no use me do Suya or Asun😌.
GOT A NICKNAME 😆😆😆
Eiii, Demola Lewis! Where you dey?
Witccchhhhhh!
Na uncle Demola give me dey yamayama name, how you go dey call pelsin wey fine like me, Witch! Who does that!
My coursemates con sweeten am, dem talk say na White Witch as per say I be ọmọ Jésù 🙏🧘♀️.
STAYED OFF CAMPUS.
Hmmm, yeah! I lived off campus during the early days of second semester. Chai, ẹ choke ooo. Sometimes, sun go beat me die, when I dey run go class Abi na days when I no get transport money when I go leg am. Omo na grace see me through those days ooo!
My people, to be a UI student, no be moinmoin ooo, na only God sure pass and as you get God, make you know how to rough am too ooo, God no be magician, na wetin you do Him go bless!
Thanks for reading through.
I do hope I was able to relieve some tension in the air😁.
Don't forget to leave your comments.
Happy New year in advance.
Comments
Post a Comment